‘Never give up’, ‘It’s never
over until it’s over’, ‘You are only a failure when you accept failure’, etc.
You done hear these things before abi? These na standard talk for anybody wey
say him be motivational speaker or anybody wey dey try ginger people to achieve
things. Sometimes e be like say the whole world dey try to teach us how to get ‘strong
head’ and dey stubborn and not to dey gree. All these talk dey sound correct
for ear when dem dey talk am sha. The wahala be say nobody dey actually remember to
tell us say sometimes e get the kind situation dem wey we no go fit do anything
about o. E get situation dem wey we suppose just accept because nothing else we
fit do about dem. And if we see am early say we no go fit do anything to change
the situation, maybe we fit manage ‘make the most’ of wetin we get at that
time.
Last week, I been go see one of
my guys for Town. The guy dey stay for an area wey we dey call Colombia. From
the name alone, I dey sure say you done already know how the area be. Some kind
strong men dey the area and na dem dey make sure say that name wey we dey call
the area no be mistake! Na the headquarters for selling any kind thing wey dey
make eye dutty for Port Harcourt be that o. Nothing wey human being dey drink,
smoke, sniff or inject wey dem no dey sell there. Also, if you dey find ‘other
things’ to take ‘help yourself’, dem dey there too.
Dope-Y |
As I see people dey take off
sharp sharp like this, I begin hear ‘Stop there! Stop there! If you move, I
move you!’ Na that time I see wetin dey pursue people so. Some men with gun dey
like say dem done catch one or two young guys and dey chase other ones. After
like one minute, e be like say na one backyard dem come dey focus. When people
see say na just a group of people wey the men with gun dey pursue dem come stop
dey look. I dey hear plenty people just dey shout up and down dey point
something for that backyard. E no tey na him I see some of the men wey carry
gun dey drag one boy wey slim like Snoop Dogg dey come out. As dem dey drag am,
one of dem dey sound him head like say e want the guy eyes to fall out. I just
waka dey go my way.
I reach my guy house and I come
dey tell am wetin I just see. So e call one of him brothers and ask am wetin
just happen. The guy say some young bobo dem been dey that backyard dey ‘solar’
themselves (dem dey smoke ‘igbo’) and dey play gamble. Suddenly, dem hear ‘Owor
o! Owor o!’ na him everybody begin vamoose! Na NDLEA done come to raid the
area. Na just two people fit escape before the NDLEA corner them for the place.
Guys just dey throway their dope inside gutter quick quick so that NDLEA no go
catch dem with the thing for their hand.
The interesting part na one
particular guy wey been see things differently o. As the guy see say dem done
corner am and no way for am to escape, na him e begin smoke the igbo fast fast.
Him guys dey shout ‘Drop am! Drop am! Na exhibit, drop am!’
The bros just dey shift dey go
back dey smoke the thing with power. NDLEA dey shout ‘You still dey smoke am?
This criminal, you still dey smoke the ‘igbo’?’
The guy just dey dodge dem dey
shout with that voice (you know that voice wey dem dey use when dem dey smoke
that thing wey dey sound like say dem lick ice-block wey come from mortuary) say
‘No need na! (puff puff) No need! (puff puff) Dem done catch me already na! (puff
puff) No need! (puff puff).’
Na so the guy take blow him ‘igbo’
finish before dem finally catch am. Na that slim guy wey I been see dem dey
sound that time.
The whole thing just make me
laugh sha. But somewhere deep inside me I understand this guy. If you go
receive punishment for something, no matter wetin you do, you know say nothing
you fit do to prevent that punishment from coming, at least make you do that thing
well! No need to dey tell yourself ‘Don’t give up’ because you know say whether
your give up or give down, e no go affect wetin go happen. Recognize the
situation, tell yourself 'No need na', then smoke your ‘igbo’ or do whatever thing wey done land you for soup!
When koboko go dey smooch him
back for NDLEA office, the guy fit dey smile....
This na @nfsqueezed on
Twitter
my people talk say if you must chop frog make sure say you chop the biggest one wey your eye see.
ReplyDeleteNa true your people talk o!
DeleteLOL... we can bear with anything so far we know why. if dem wire im back with koboko, im don enjoy the sin just dat, pleasure before pain no be sweet thing!
ReplyDeleteAbi o!
Delete