Those
days when we still dey primary school, TV no too plenty and coloured TV dey
very hard to find. You sabi how some of those children dem, wey get coloured TV
for house, go come school come dey tell us how Rambo blood na green if we see
am for their TV, abi? Since na for black-and-white TV we dey watch our own
Rambo, how we wan take drag with dem na? The coloured TV wey I dey talk about
na proper coloured o. No be those black-and-white TV wey dem go carry purple
waterproof cover and dem become coloured o. Anyhow, we dey like to watch WWF
(wrestling) in those days and e dey sweet to watch am for colour. The wahala be
say na black-and-white TV we get for house. Anyway, e get one house for our street
wey dem get coloured TV. So, na there we dey like go watch am, but the wicked
people wey dey live there no dey like let us come full their parlour to watch
TV. The solution na to gather for their window, and na wetin my grandmama hate
be that. She no fit understand why I go leave TV wey dey my house, go stand for
another person window to watch TV. She warn me tire make I no dey go there but
I no dey hear word. Once I see say wrestling time done reach and she dey sleep
for house or she done comot, me sef done run with my friends to that house and
take position for the window!
Courtesy: ClipProject |
E
get so many other things wey my grandmama been do me o. Strong things wey I no
go forget. Those people wey say grandmama dem dey spoil grandpikin dem no meet
my grandmama o. She go tell you say ‘I dey sweet, but I dey bitter too!’ You no
go understand wetin e be until, one day, your cup go full and she go treat your
mess up like I just describe or in another way. Which one I go talk and which
one I go leave? Abi na when she been dey come find me for football field and pursue
me go back to our house with cane or na when she dey threaten to pour one girl (wey
been dey come find me) water, if she no leave me to read book? What about those
12 midnight flogging dem? You know when you done shit big shit for church (that
na your house) and you go just dey avoid your house dey hope say if dem no see
you dem go forget wetin you do, abi? My grandmama no dey forget o. When I play
outside tire, I go quietly enter house for evening. She go tell me say make I
go take my food chop. When I chop finish, na TV and sleep. Around midnight,
hand go just tap me. When I wake up, na my grandmama. Then we go siddon and
discuss the sin wey I commit that day and depending on wetin I been do, the cane
fit show. All that hide wey I been hide? Rubbish! She no dey forget narthing!
I
think of my grandmama sha and smile because of the kind work wey she and many
other grandmama dem done do for our lives. Work wey we no dey really thank dem
for. Anybody wey get correct grandmama, go understand wetin I dey talk. The
kind wahala people dey give their grandmama dem no be small thing. I know one
boy wey been sabi cry well well. When the boy don begin dey cry anyhow and
nobody (including him mama) gree answer am again e go waka go meet him
grandmama. Wetin you go hear na ‘Mama tell me sorry’. Mama go do like say she
no hear. ‘Mama tell me sorry na.’ Mama still dey chew chewing stick dey look
another place. ‘Mama naaaaa, Mama….’ E go dey cry dey drag him grandmama
wrapper. Mama go come say ‘Hey, this pikin! You wan naked me? Oya sorry, no cry
again’, then she go carry am. The things wey grandmama dem dey see! This boy
now done tall like dongoyaro tree and dey drive big motor, but thank God say e
no dey drag him grandmama wrapper again. Na skirt and jeans e dey drag these
days and e no mind who wear am!
Na
as I siddon for house, late in the evening on the last Mother’s Day after I
done address that girl Facebook status message finish (you remember her, abi?) na
him I begin think of these things…. While everybody busy dey write plenty
status messages and tweets about dem mama, I no see any message for anybody
grandmama. Abi people wey dey use Facebook and Twitter no get grandmama dem
again? Or maybe on that day everybody grandmama na winch! No, I no mean everybody.
Your grandmama no follow o. Na those other people own I mean. I sure say your grandmama
too take care of you like my own do me. The thing wey fit different na the ‘pattern’
wey she use.
As I
look back now, I realise say without all these strong things attached to their love,
care and devotion, some of our lives for no be as e be today o. My life for
scatter scatter like Terry G dada! So I dey remember my grandmama on Mother’s
Day too and I say ‘Mama, thank you and continue to rest in peace where you dey.
When I reach there, Mama, I go try to behave myself as you always want am. But
just to dey sure, I go also try to hide that slim cane (Yes, na me been dey
always hide am!). I dey make all these plans because something dey tell me say even
though dem no dey allow cane for that place, you go done manage find your slim cane
and you keep am somewhere dey wait for me!’
This na @nfsqueezed on
Twitter
Dis na very interesting read. I enjoy am well well. Make u continue e ya.
ReplyDeleteThanks for stopping by. Make you back again and check out the other posts.
DeleteMy Wanne,na wetin I dey call my grandmama.Ur story just remind me of my Wanne,She dey swEet,n she dey bitter too...if I start to write abt her na tmr I go finish..I just happy 4 d training wey she gv me,happy pass cos nw my mama don dey behave like her mama,e mean say my pikin dem go enjoy...
ReplyDeleteMe,I no jam black n white tv days oh,I knw say I be small pikin!!! Hahahhahahahahahaha
You no jam black-n-white tv? Chai, you miss! Those days the TV dem dey big like Siverbird Cinema screen and the actors dey jump come out come follow us chop garri. Also, the....
DeleteNo mind me, abeg. Na lie I talk. You no miss anything. Thanks for reading.
Una don make me dey miss my grandma.I LOVE MY Grandma,Even though she is late now.
ReplyDelete