I dey vex. Yes, I dey vex. Yes,
no remind me say no be only me dey vex. You sef fit dey vex right now too. E
fit be say your laptop computer or your phone dey about to off now as you never
charge am because of NEPA (or PHCN if you believe wetin dem dey tell us). E fit
just be say you just see lipstick stain for him shirt and him dey rake say ‘something
no fit stain man shirt again?’ Or e fit just be say… Over-yarning! Wetin I dey
talk be say you sef fit dey vex like me for something wey dey happen for your
life or our country
Wetin dey make me vex now na
exams. Last time I talk about exams and some kind things wey I done experience
wey dey make me laugh anytime I remember them. True true, exam wayo and expo na
bad things, but sometimes the way these bad things dey happen and dem dey make
us laugh. But that na sometimes. In fact, na few times. Most of the time e dey
just make belle turn person (that is if no be you carry the bullet or dey do
the dubbing). Right now my belle dey turn me.
No need for this! |
‘I think say you done already
pay exam fee. Wetin you wan carry N1500 do?’ I ask.
She say ‘If we no pay N1500,
dem no go even let us enter the hall o!’
I open eye, mouth and nose dey
look her. ‘How?!’
‘The other day wey we write
Biology Practicals, na wetin happen. Na my friend borrow me the money I use
pay. And dem say when e reach Maths and English, the price go go up.’ She dey
explain.
‘You sure say no be for expo?’
I reply.
‘Dem say with that one, we fit
do anything wey we like. So even if you no wan copy sef, you must pay the money
or dem go frustrate you.’
I wan mad! I no fit understand
wetin I dey hear. I know say exam malpractice done come to stay for our system.
At every level e be like say to copy or bring somebody to write exam for
another person done turn to normal thing. E no dey like say anybody get problem
with am. Nobody dey really complain about am. But I no know say we done reach
that level where we dey insist say people must copy whether dem like am or not…
or dem must pay to copy whether dem wan copy or not. So this girl wey wan write
her exam, the way exam suppose dey, must pay money now or she go fail.
I ask her about their teachers
and she tell me say na dem and the External Supervisor dey do the thing.
Principal nko? She dey come inside the hall sometimes, look the area and see
say the dubbing dey go on fine. Then she go waka! Principal too!
This na the very way! |
So now we get problem wey get
different parts. We dey tell our young people say all you need for this country
na to pay the right amount of money and you go get anything you want. We dey
tell the children of poor people (wey their parents done struggle to pay exam
fee) say dem no fit pass unless dem go thief. We dey produce secondary school
leavers wey no know dem left from dem right. Then dem go use magumagu enter
university and dem go continue to dey pay until dem graduate. Which kind
graduates wey dey expect then? The type wey dey ask ‘Abeg where I go turn?’
when dem hear command of ‘Left turn!’
We human beings go always try
to cheat the system and get everything wey dem fit get from am without
punishment. But we expect say the system go dey make attempt to prevent people
from succeeding. But in our own e dey like say the system dey actually make
sure say people wey no wan cheat sef dey cheat! Only for Naija…
Also, make we no forget say
this examination malpractice thing na criminal offence o. Actually, according
to our law, person fit go prison for 21 years if dem catch am dey do this kind
thing. Ehm… we still dey wait for the first person wey go go that prison sha.
Seriously sha, we need to do
something. We no go fit continue like this and expect say our country go
better. Personally, I get plans. This man wey wan chop N1500… Hmmm… I sure say
e no dey read newspaper. Because if e dey read newspaper e go done read about Farouk
Lawan, Femi Odetola, Bribe Money and Sting Operations….
This na @nfsqueezed on Twitter