Generally, most people fit try
make sensible arguments about most of the things wey dem dey do. Even if you no
agree with dem, you no go fit talk say dem head no correct. When the issue
enter politics and religion sha, e dey change o. Politics and religion na
topics wey dey make even those people wey sharp well well begin to craze. For
Naija you fit add ‘tribe’ and to that list.
Before the General Elections of
2011, I been dey yarn with some family and friends about the presidential race.
Wetin shock me be say, these people wey I dey yarn with so, na people wey you
go consider smart in every area. Dem go school, dem done see things, dem dey
successful and dem fit contribute well to any discussion. But in this issue of
politics, dem no dey make any sense. I ask somebody who e go vote? E say na Jonathan.
I ask am why. E say na because the man na one of us (na Niger Deltan).
‘E done reach time wey we
suppose rule o. E done too much for the Northerners sef. Abi na only dem dey?’
E tell me.
I look am and I smile. ‘So na
just for that reason?’ I ask am.
‘Yes, na our time. Make
Christian rule too.’ E answer.
We argue plenty after that,
until e vex say ‘Carry your oyibo ideas comot here abeg!’
But before e vex, I tell am
three things.
(a) We know say most of us no dey see steady light
for this country at all. If today, you begin receive steady light for Port
Harcourt, you go test the light to see whether na Hausa or Yoruba light? You go
reject the light because na Hausa man be president? Or if dem finally construct
road come reach your house for village, you go say you no fit use the road
because no be Ikwerre man construct am?
(b) Wetin be the benefit wey we dey get if somebody
from our part of the country become president? Afterall, our state governors
from ‘our part’ of the country. Ibori no be Delta man? How far? Corruption no
get tribe or religion. E dey everywhere. Just as Southern Christian politicians
dey thief, na so Northern Muslim ones dey thief too. But the more important
thing be say just as every part dey produce thieves na so dem dey produce
excellent Nigerians too. Why we no go forget where people come from or wetin
dem dey worship and look whether dem fit do the work?
(c) Our people say ‘Na from mess smell you go know
shit smell’. Jonathan done be Deputy Governor, Governor, Vice President, Acting
President and President. And honestly, I no really see wetin e done do for all
these positions. And e never even promise us anything apart from fresh air. For
my mind, that na smelling mess. So why you think say him shit go be perfume?
Courtesy: genealogyreligion.net |
All over the country now petrol
na at least N97 per litre. For some places e pass that amount. Both for
Northern Nigeria and the Niger Delta, our pockets dey cry out. E dey cost more
now whether na church or mosque or babalawo house you wan drive go.
Light still no dey o, but our
light bill done go up sharply. That increase of light bill na for every Naija
person wey dey use light. Somehow, our wonderful government done get something
wey go tell dem who get money and who no get. That way NEPA (or PHCN) go bill
people wey get money more. Somebody been tell me quietly say dem dey advertise
for dibias. Ehm… no talk say na me tell you about the dibia dem o. I go deny
you!
And we go soon begin chop
cassava bread, by the way. I no know how e go dey, but any day wey I chop bread
and e smell like fufu…
Try remember say people wey dey
make us suffer like this from every part of Naija and dem dey worship anything
dem like. Christians dey, muslims dey and jazz
men dey too. Their religion no help us one way or another. The suffer no be
Christian or Muslim type of suffer. Na Naija suffer!
Normally, I suppose believe say
when the time come to do something about our present problems, we go do the
correct thing o. Like every ‘good’ Naija man, I dey ‘pray’ say e go be like
that too. But as I done learn, with ‘smart’ Naija people person no dey know dey
know finish….
This na @nfsqueezed on Twitter
True talk my broda. I dey pray for the day when our people go open eye, put person for seat wey go actually do betta something for we country.
ReplyDeleteBros u don talk am finish. Who get ear make e hear ooo
ReplyDelete