Na Karl Max wey talk
say religion na the opium of the masses. Meaning say na wetin we dey use ‘high’
ourselves so that we no go face reality. I agree with am completely on the
issue. But I also know say opium no be for dulling alone. E get other very good
uses wey make am important. Na so religion be too. And before you begin ready
to call down the anger of God for my head, this yarn no be about religion, so
make we move on.
Courtesy cutesexyfunnyawful |
Like most Nigerian
guys, I love football. I no really know why I love am. I just love am. I
believe say e dey my blood. I say e dey my blood because I know say my
grandpapa been love am too. I fit remember as me and him dey siddon with him
old ghetto blaster dey listen to Radio Nigeria football commentary. When Naija
dey play ball and light no dey to watch am for TV, na the style be that. The
way commentary been dey those days, we go done shout ‘goal!’ like 5 times
before dem actually score one! We no mind sha. We dey enjoy am.
I also remember say
when Enyimba win the CAF Champions League final with penalties, I no fit watch
the match where I dey. So, I use my phone to listen to commentary of the shoot
out! And I jump and jump when dem win. Yes, I love Naija football reach like
that, and I know say I no dey alone for that situation.
In fact we plenty wey
be like that. Just check out the way people dey stand in front of any building
wey get TV wey dey show football on weekends and you go understand. I look back
now to the period between the late 80s and mid 90s, when Naija football been
solid and I wonder. Though we been never begin watch the Premiership or
Champions League as we dey watch am today, we been like our local league and
our national teams. And e look to me like say instead of just religion then, na
religion and football been be our opium.
If you no believe say
we use football dey ‘high’ ourselves, then you no remember Japan ’93, Tunisia
‘94 and Atlanta ’96. The kind of attention wey we give those competitions and
the kind of joy wey we get when we finally win, no get mate. For ’96, at a time
wey Sani Abacha done turn our country to wetin-I-no-fit-describe, I remember
women dey run for street with happiness and wrapper dey fall from their waist!
People dey carry wooden Olympic Torch, beat drum and sing for street for 2am!
Somehow, for the period wey we go talk about and watch the football, we dey
forget all our problems. That na unless NEPA take light o! Because, we done
hear stories of how people go beat NEPA officials because light go during
football.
These days, things
done change. Our football dey add to our many problems. Countries wey been dey
fear when dem hear our name before, now dem dey make noise. And no be just
noise o. Some of dem done stop us make we no go World Cup and African Nations
Cup. Our teams no dey fit qualify for Olympics again and even the age-grade and
female competitions, where we dey shine before, done dey hard us. Which way
Nigeria?!
So, now we get a
situation where Naija people dey pretend say dem no get interest for Naija
football again. We know say na pretend dem dey pretend, because e dey inside
blood. You go ask somebody whether him watch the last Nations Cup Qualifier and
if Naija been play well, e go say e watch am. If we no play well, e go say e no
been know say match dey sef. But I understand say dem dey try to protect
themselves from the heartbreak wey dey follow Naija football. People dey soak
demselves inside European football and try not to remember our own.
But no matter how
European football sweet, e still no sweet reach when we win the Nations Cup in
’94 or the Olympic gold in ’96. That collective feeling of highness na the very
one. That joy wey dey cut across all the boundaries of tribe, religion and
status for our country, na something wey we no fit measure. E unite us pass the
Fuel Subsidy removal wahala for January 2012 sef. Na that joy we done dey miss
for years now.
I agree say we get
very serious problems for our country. Problems wey big pass football or any
other sport. I know say if we begin win football matches again and other
countries begin fear us like before, e no go really change our suffer for this
country. The suffer go be the same. But then, if we begin win football matches
again, na bad thing? True true, to get back to the time when we been dey do
well for football go take plenty hard work from different people. The world
done change well well and we need to do something to catch up. I know say we
fit do am, but whether we go actually do am na another matter.
But, like the person
wey done take opium before and we know the sweetness, I know how e dey be when
Naija win football competition and I no go mind to ‘high’ myself again. Because
now, more than before, we need something to (once in a while) comot our minds
from the way our country be. We need something to give us joy, even if na for a
short time.
If you say I be
addict, I go agree with you. If you say my head no correct, maybe I fit argue
small. If you say I need rehab, I no go gree. I no need cure. For our country,
this football drug good for us. E dey work magic. So, somebody… anybody… abeg
give us the opium!
This na @nfsqueezed
on Twitter
My friend I agree with u,even though say football no dey high me,but I still remember atlanta 96 becos na the shout of my dad and brothers wake me up,me sef follow dem shout and jump,dem even buy fanta for me that night,I been get faith for eagles then.so even though say football no be my thing,I been get pride for my country then cos I know say other countries dey fear.I wish say we go fit go back to those times,I only dey fear say boko haram fit bomb the whole stadium during match
ReplyDeleteNa good thing say you dey remember the good times. Times when even people wey no really send football sef dey feel the joy. Hopefully, Boko Haram go dey enjoy the football too much to want to spoil that one too. Hopefully...
DeleteAfter all, something must start from somewhere...
ReplyDelete