Anybody wey dem born for or wey
grow up for our country Naija know one or two things about spirits. When I
small, spirits na those things wey dey appear with white cloth not very far
from you when NEPA take light and the whole place suddenly dey dark. For people
wey grow up for those parts of town where you go need to go piss for backyard,
na big wahala be that o. Piss go catch you reach the level wey you go dey do
break dance, but you no go still wan go backyard go piss because of spirits.
Nobody want spirit to carry am go!
As I dey grow up, the whole
idea of spirits come dey change. I no dey fear those NEPA spirit things again.
In fact, e get the time wey man dey pray make dem take the light sef so that…
You understand, abi? My idea of spirits done mature with time and now e done
reach the point where I know say for Naija, everything get spirit. Na dem dey
run things. You go understand wetin I dey yarn about now now.
Some days ago, I siddon for
lounge for airport dey wait for flight and somehow the gist wey some people wey
siddon near me dey gist come interest me. I leave wetin I dey read, begin
listen to dem yarns. From the gist, I understand say the woman among dem na
senator, one of the men na pastor and the other one na top federal civil
servant. Dem just dey return from pilgrimage to Jerusalem.
The pastor say ‘Nigeria cannot
get it right, provided our foundation is not in righteousness’, and the senator
and civil servant agree, with plenty spiritual grammar. You go know say dem dey
go church well well. I turn look dem and the question wey enter my head na ‘Una
done hear about a country wey dem dey call China? What about Malaysia and
India? Na ‘righteousness’ dey move dem go front?’
I decide not to put mouth for
their tori. Afterall, dem no been dey talk to me. The next thing the pastor
talk be say ‘Jonathan cannot succeed until we remove the Spirit of Corruption
from public office’.
Ah, spirit! After dem blame the
way our country bend on ‘foundation wey no righteous’, dem done move the blame
to spirits. I smile and shake my head.
Brothers and sisters, the spirit dey alive! |
Plenty questions enter my head
and na manage I manage not to begin fire these people with questions. I wan ask
the senator how much dem dey pay her every year and whether e dey okay to be
one of the politicians wey dem pay pass for the world, for a country wey get
some of the poorest people for the world and which spirit possess her when she
dey collect that money. Spirit of Greed? I wan ask her who pay for she and her
friends Pilgrimage and which spirit possess the person. Spirit of Mumu? I wan
ask the pastor, wey talk say him happy say pastors for Nigeria done dey speak
out against our corrupt politicians, which spirit done possess am? Spirit of Lying?
Seriously, this whole spirit
thing dey turn my belle. The way I see am be say, we done take our religion and
twist am into the way e sweet us. Instead of us to take responsibility for our
actions, we dey find am easy to just shift the blame. If we no fit put the
blame for another person head then we go put am for spirit head. Afterall,
spirit no go come defend himself.
I done read for newspaper about
a man wey rape a 7-year old girl. When e go court, the first thing e talk na
‘My Lord, please temper justice with mercy. It was the work of the devil.’
If I be the judge, I go tell am
say ‘No problems, my friend. We will impose the maximum sentence for rape on
the devil and not you. Until he shows up though, you will have his place.’
Another man, wey him wife catch
with another woman, no even bother blame anybody or spirit sef. E say ‘I’m so
sorry, honey, I don’t know what came over me.’ Really?
I believe say the time done
reach for us to begin take responsibility for the things wey we dey do, the
things wey we suppose to do and we no do, and the things wey dey happen for our
country. Time done reach to leave the spiritual and face our physical. I no
believe say na the Spirit of Gluttony go make our president wan chop N1bn food
for one year o. I also no believe say na the Spirit of News go make am wan read
N45m worth of newspapers and almost N9m worth of magazines for one year. What
about the N265m for computers wey dem been buy last year too? E no fit be
Spirit of Repititive Computer Purchase!
So, when you leave your motor
for road wey dey slope well well and you no put the hand brake on and the car
roll back go kill small pikin for road, no be the Spirit of Death or wicked
people from your village cause am. Na just gravity and your own carelessness.
If you begin insist day you go bring spirits into the matter, then I hope say
the Spirit of Truth and Justice go possess the police and them go carry you go
court where the Spirit of Toothache go make the judge to provoke and e go
sentence you to enough jail time, so that you fit experience the Spirit of
Overcrowding, Spirit of Heat, Spirit of Strong Body Odour and some other spirits wey I no go fit talk about
here!
As we dey enjoy this time of
the year when the Spirit of Jollification go possess most of us, make we enjoy
with common sense and dey remember say we go dey responsible for all the things
wey we do. Make we also come back from our jollification with a commitment to begin
hold ourselves responsible for our actions or lack of action, and also hold
other people responsible for their actions or lack of action.
Merry Christmas.
You talk well, my broda. Dis shifting cultivation wey we dey practise dis side dey always tickle my belle. One day, one day, God go comot spirit of spirit from inside us.
ReplyDeleteNo be small thing o. That spirit of spirit must vamoose!
DeleteWell done my broda. E be like say dis shift shift of blame na em dey reign for our leaders now! But when we go wake up dem go know say water no be garri mate!
ReplyDeleteYou write one very well. The problem for this we country be say everybody dey blame everybody/thing else for his mistakes. And the people wey dey lead us no wan take the responsibility to to the better things. Instead, dem dey busy dey try fill their pockets as if stealing dey go out of fashion. Even the "legal" things wey dem dey do dey very criminal. Example, eat 1bn naira worth of food for one year.
ReplyDeleteAnyhow, till dem remember say the country no go finish after dem rule finish, say their children go still live inside. Maybe na that time dem to begin do the right things.