One thing
wey been dey common for people wey grow up for ajepako area na to dey give
person guy name (nickname if you be ajebutter) whether because of how the
person been look or because of wetin the person dey like to do. For example, if
person get big head, boys go dey call am Edmund /HEAD-mund/, Edwin /HEAD-win/
or one kain name like that. If na the person nose been dey ‘important’ for him
body, him guy name go be like Nosakhare /NOSE-I-carry/, for big lips na LIPton,
for big eye na Isaac /EYE-saac/, for person with big hands na Andrew /HAND-rew/
and so on.
Some of these nicknames na to hail the person but some dey
wey we dey use to abuse person or to talk about the kain bad habit wey the person
get. That kain time, the name na to use warn people wey dey around make them
take beware for the person. For example, if person sabi thief them go dey call
am Tiffany /THIEF-any/. So if the person dey around you, boys fit talk
something like ‘Guy, hold ya wallet well o, dat babe wey dey near you na
TIFFANY,’ and if you be sharp guy, you go just code and arrange yourself well
so the person no go do you strong things.
But the kind people wey their own bad habit they vex me pass
and wey I wan talk about na the people wey like to dey lie in and out of
season. This kain people we dey call dem LINUS /Lie-NUS/ if the person na man or LAIDE /Lie-dey/ if the person na woman.
We still dey wait for Linus pant to catch fire for Naija |
I agree say almost everybody dey lie at one time or another
and no be everytime wey people lie e be for bad purpose, but for people wey be
LINUS or LAIDE, lie na their way of life. In fact, e done dey their body to dey
lie sotay if you ask say wetin be their name, dem go first tell you wrong name
before dem go say ‘sorry oh, na lie,’ come tell you their real names.
I bin sabi one LINUS when I bin dey serve (NYSC) for
Nasarawa and the guy na senior lie lie person. This guy own problem be say, no
time wey him no dey lie and nothing wey him no fit lie about. If dis guy greet
you say good morning, you need to check time again because e fit be lie. This
guy nack us one wicked tori one time so. E say him carry Army officer motor go
somewhere and another officer from Abuja come see the motor begin pursue am. Two
of dem come dey run at high speed (like say na Formula1 for this our bad roads)
before another officer come intervene say na him give the guy motor. Another
lie wey the guy bin tell us be say him sleep on top tree from night till
morning when armed robbers attack them for night journey. In fact this guy fit
tell you say him dey listen for CoolFM or any other radio station when him
enter plane or say him dey there when dem do him senior brother naming
ceremony. Ok, I gree say the last one fit hard am small, but you done understand
how LINUS dey behave now abi.
Seirously sha, among our leaders, e be like say we get
people wey be professional LINUS. For our Federal Government sef, dem dey! Dem
no dey fear to lie give anybody o. To lie give ordinary Nigerians na small
thing sef. Dem dey another level. Na so dem go lie give Oga Presido sey Nigeria
don improve for one kain corruption something-something, and Oga Presido no
check well before e come out for public and repeat the lie. If to say sharp
people and some oyibo dem no shout ‘Haba! Why una dey lie?’ we no for hear the
truth.
Na the same Spirit of LINUS wey dey our government body na
im make dem tell us say Madam First lady no sick and she just go abroad go
‘rest’, but dem still ask us to pray for am. Abeg, if person wey just dey ‘rest’ need
prayers, wetin person wey dey sick go need? All the lies wey our government don
give us done make me belief say na LINUSOCRACY we dey practise for Nigeria. We
done reach that level wey if you no sabi lie, e fit hard for dem to gree make
you work for our government.
Abeg, make I ask some questions sef. Why people dey tell all
this mature lie dem? If we no lie, we go die? Why person go do something wey him
know say bad come lie say na devil cause am? Where e see devil? Plenty other
questions dey to ask, but no need to go there. I done realise say LINUS dey
everywhere and everybody wey dey lie get the LINUS FACTOR for their body.
So, before you lie next time, make you ask yourself say ‘this
lie wey I wan talk so, I really need to talk am, abi I just be LINUS?
Till we see next time, my name na Gbenga (no be LINUS o!).
Make we yarn for twitter @gbengaosowe
Linusga, well done o. Proponent of linusocracy.
ReplyDeleteSir! Na like that we see am o! LINUSOCRACY-- Government of the Liars, by the lying over the lied-to. If u no fit lie, no way for you
Deleteheheheh! Jonas and Gbenga, you will both soon be locked away. Good work!
ReplyDeleteThanks Oga mi sir! I know say as a lawyer, ur level go pass LINUS, na LIONEL level u go dey! Abi Oga Jonas, no be so?
DeleteEhm, no insult Ayo na. The guy dey different level. We know say na LLD (Lie Lie Don) him dey go. No try bring am down to Lionel abeg.
DeleteGbenga,u do well jare. Ds article suppose give our big bros Jona new name as LIATHAN.
ReplyDeleteSo him new name na JOLIETHAN GOODLUCK! Hmmmm, we go suggest am to National Assembly!
DeleteU r on ur own o. I no sabi u at all o.
DeleteHa! Aunty Mi, No deny me na! Yu be my one & only Aunty LINDA na!
DeleteLaiwola nko? Nice one, Gbenga...
ReplyDeleteThat na correct one!
DeleteLAIWOLA/LIE-WALLER/ That one na serious one oh! E done enter dictionary too
DeleteOga Jonas, wetin happen naa? i don come ya blog tire to read something new yet nothing. Na holiday u take???
ReplyDelete