Thursday, September 6, 2012

Where Our Own Paul?

by Unknown
For the past few months, I done dey see news from Presidential Primaries wey the American Republican Party dey do. And for the past two weeks, I dey follow am with plenty interest. Recently, Mitt Romney, the  man wey done win the party primaries to contest for president against Barack Obama, choose Paul Ryan, Congressman from Wisconsin, to be him running mate.

As you fit already know, American politics no dey directly affect me one way or the other. But I dey follow am with interest because na their system our own resemble pass. Na from dem the ‘wise’ people wey write our Naija Constitution copy plenty things from.  The problem be say, like person wey no read before e enter exam hall and e dey dub from him neighbour, we copy some things upside down and  we forget to copy some other things. That na matter for another day sha….

I never hear of this Paul Ryan guy before, but as dem make am running mate so, plenty tori just dey fall out. Dem say the guy na very sharp guy and him star dey rise quick quick for the party. People like and respect am because him na one of the people wey dey think correct and create policy for the party. In fact, e done come up with plans wey him party believe say go move their economy forward and dem done actually debate these plans for the US Congress.

The interesting part be say, even people wey no dey agree with the way the guy dey think and people wey no dey the same party with am, still dey respect that man. Dem fit no gree wetin him talk but dem know say him get brain wey dey work well for him head. I never hear any gist about him godfathers for the Republican Party or which part of the country him from yet. I dey wait. If CNN no carry that gist, I go tune NTA.

The whole thing make me begin think. Who be the Paul Ryans for Naija politics today? I mean, who be those politicians wey dey siddon and really think about our problems, and the government policies wey suppose dey solve these problems, then come up with their own solutions to these problems if dem no agree with the government own?

I no dey talk about who dey criticize the government o. Because, almost every Nigerian wey no dey chop from government dey criticize government. Even people wey dey chop sef dey criticize quietly when tatafo dem no dey around. I dey talk about people wey dey criticize, point out where government dey fail and tell us how dem go take change the direction wey government dey go. To grumble and complain done become national sport for our country now. I no fit count the number of times I done hear 7-year old children shout ‘This stupid NEPA!’ when light go. We dey start am from small.

Nothing wrong with to grumble and to complain o. Na our right. But on their own, Chief Grumble and Alhaji Complain no dey solve any problem. If we agree say some policies no dey work, then we need new ones wey we believe say go work. That na wetin suppose follow the grumble and complain dem. And that na wetin the politicians wey no dey the ruling party, wey we done already elect, suppose dey do. The opposition parties for Naija suppose dey full of people wey no go gree the government sleep well for night; people wey go make government reason well before dem make any move.

Right now sha, I no know whether na government or opposition dey disappoint me pass. Dem plenty for the National Assembly, but nobody dey hear their voice at all. Anytime serious matter dey to yarn about, e be like say all of dem dey fear to talk make we no remember say dem follow dey share the money there! Sometimes, I dey actually wonder if dem and the government dey actually disagree on policy. All, I dey hear from opposition na how dem go dey ready for the government by 2015 and how e no go easy for government and how government no go rig elections… blah blah blah. The only thing dem never succeed to explain to anybody na why we need to change the PDP. Why we go need to come out for 2015 to vote sef? Because, to change something just because you like change, na mumu be that. Change suppose get some kind meaning. If we dey change, e must be for the better. Otherwise, no need for me to waste my time.

If we all done agree say na through democratic way we go take move this country forward, then we need some Paul Ryan-kind of people and we need dem right now. We need people to begin give us alternatives now. We need people to begin draw that line of difference between wetin we get now and wetin we fit get after the 2015 elections. We also need dem to begin ginger the common man for the streets to see say change dey come and to see the faces of this change wey dey come. If these things no begin happen now, then when 2015 come, even if by miracle, we remove the current government and put new one, e go be the same old wine inside new bottle.

This na yarn wey we done begin talk before today. E no go end today. Make the yarn continue…


For Other Matter…

1.    Dana Air
The Federal Government done give back Dana Air their license to fly for Naija again o. If you been never hear am yet, you dey on a very long thing.

From the reactions wey I see yesterday, e no dey like say most people dey happy about this development, especially after we hear say dem suspend the inquest into the crash. As I done talk before, na issues like this suppose be the bread and butter of the Opposition. This na good time for some opposition politicians to tell us say dem dey feel the people.

Also, e go good to see that Naija man wey go be the first to buy Dana Air flight ticket. I say ‘man’ because I trust our women.… Not their portion!


2.    Trial For Suicide
I hear say Naija Police for Abuja take one man go court because the man attempt to kill himself.

Now, I no be lawyer and I no know where the law dey stand for this kind matter o. But, I think say person wey try to kill himself need help. And I no believe say the kind help the guy need na court case and prison o! Which way Nigeria?


This na @nfsqueezed on Twitter

Read more >>

Tuesday, September 4, 2012

Small Pikin Things

by Unknown
I hate heat. I never ever like places wey hot for my life and I no think say I go ever like them. I no go mind if we dey get winter for Naija. In fact, I be one of those few Africans wey no go mind import weather from Europe. No fear when you hear import o, because na government go pay for am. Full subsidy. Ehm… subsidy… make we no go there.

Right now, where I dey air conditioner and heat done dey battle since morning and at exactly 12.58 pm, the walls of Jericho around the air conditioner fall down flat, and the heat finally defeat the AC. No way to fix am right now so I get to endure am.

I bring out my external hard drive, connect am to my computer and begin find music wey I go listen to, to take distract myself from the heat. I see some music wey I never listen to for many years now – the first three albums of DMX. I no understand how I still get this music and I never listen to am for years now! So I begin play am. Make I for no disturb my colleague, I form like person wey wan represent him country for the Olympics (maybe for the Ludo/Draught event) and I use headphones. You know say I no see any Nigerian athletes with those Beats headphones for the Olympics o. Some people say e affect our medal chances. If Dr. Dre no gree dash dem headphones, why our government no buy for dem na? Anyway, that one na by the way.

As I begin listen the music, I dey sing, dey dance. You know that special dance wey you only fit dance when your hands dey on top computer and you siddon, abi? Only your head, shoulders and chest (depending on the size, shape, reaction to gravity, things wey dey hold am, etc.) fit shake dey shake. My colleague just open mouth dey look me. I no look him face. I notice say him mouth dey move, so I pause my music and remove the headphones.

‘You always listen to music, but whatever you are listening to now must be special. You are singing and dancing’, the guy tell me.

I put the headphones for him head and I play the music. The guy look me with shock for him face. If you see him face you go think say e hear somebody dey recite incantations to him town juju. I take my headphones put for head and continue the music without any explanations.

I discover hip hop when I enter secondary school. I mean, I done dey hear am before that time, but na when I go secondary school I begin dey actually listen am well. I no fit really explain wetin dey about the music wey attract me o. But I been get my group of hip hop heads wey dey discuss and share the music. Most of wetin the songs dey about na babes, dope, fighting and killing. And I no really get problem with dope, fighting and killing, as far as na only for TV dem dey. As for babes, I no mind if dem show physically.... Some of the lyrics dey so bloody that I no fit play am loud if adult dey near me. Sometimes, I fit forget say my mama dey with me and one ‘rotten’ part of the song go just come out. I go just bone, put my face inside book and pretend say I no been dey listen. Na wetin make me get my first headphones. Na later I realise say to my people, na rubbish I dey listen and dem no dey bother themselves to actually hear wetin the rappers dey yarn about. As far as no be disco or highlife, dem no send! Violence or not, I been love hip hop with all my heart.

Oh, before I forget, I mean the kind of hip hop wey dem been dey play in the 90s and early to mid 2000s o.  Because these days the music and the musicians done change small. E be like say if dem no put plenty braces for mouth and turn their body to small pikin writing pad,  the music no go sweet. Somebody say no be braces; say na platinum teeth and say na professional tattoo artists dey do the drawing and writing. I never confirm yet. As for the songs dem sef… I tire. Dem all sound alike.

Around the same time wey I discover hip hop na him I begin play video games. Those days Nintendo and Sega been get some games wey dey scatter my dada! But I been really like the fight fight ones. Mortal Kombat and Street Fighter been bam well well. Every day I dey try to learn new combo wey I go take dey kill people. Other ones dey too, where you go just carry your sword or gun begin dey nack people everywhere. One man genocide squad! The sweet thing be say if dem kill you, you fit restart and you go come back to life! And even if the people wey you been done kill before come back to life, you already know say the way to kill person na the same way to kill him ghost and the ghost of him ghost too!

My love for hip hop and video games continue up till university and after. But over time, so many other things done dey chop man time and I no dey really fit do those things as I been dey do before. But today na different day. Thanks to the combination of heat and my old hard drive wey no dey die, I done remind myself say my feelings for hip hop never change. I realise too say I dey miss finishing people for Mortal Kombat and those other games. I dey go buy proper video game as soon as I fit. Time go dey to play am. I hear say for some of the games, you fit even customize and name your enemies and opponents. Chai, na only God know how many Naija politicians I go dey beat everyday! With their big big belle dem, e no go hard. Any one wey wear cap, na him head I go kick first. Money fit fall out. Maybe N5000 notes. I no go forget to add Boko Haram too.

I sure say everybody get things wey dem been dey do as children wey dem still love as adults. My own na hip hop and video games. Wetin be your own? Dem say ‘there’s love in sharing’, so drop a comment for under and share am with us.

By the way, this my colleague just look wetin I write finish begin tell me about somewhere for Bible wey talk say ‘When I was a child, I spake as a child… when I was old, I put away childish things’. I look am and I laugh and I continue to write. See worshiper of the Nigerian god! For my bible, that part of the bible actually say ‘…when I became a man, I put away childish things’. Na just music wey I dey enjoy and e no get upper age limit o! When we dey drive home this evening, we go pass in front of cemetery. I go show am where old people dey…


This na @nfsqueezed on Twitter


Read more >>

Tuesday, August 28, 2012

I Remember

by Unknown
I remember when I small. No kind play children no been dey play - backflip, cartwheel, rubber leg, running, high jump, long jump and even poju poju. My street na 100m track for us children. No evening wey you no go hear ‘On your marks, set, go!’ outside our house. Our parents dey actually come out for our houses and watch us as we dey arrange ourselves dey run. We dey make small small ‘machines’ wey get wheels and dey push dem all over the place. Some of us dey carry old bike and motor tyres dey run for street. Sometimes they tyre dey even big pass the pikin wey dey try to push am. We been dey wrestle too. Those of us wey from villages wey dem dey wrestle come introduce am to us. But we no dey do am where our parents go see us. If not, na cane we go wrestle with. We bin play many games wey if to say we do am till we grow we for be professional play play people. I mean, I been dey very good with my catapult. I dey shoot anything wey dey move. I enter trouble a few times because of am too.

I remember say the navy men wey dey stay for the NNS Pathfinder Base (that time na NNS Akaso) dey like to jog for morning. And dem no dey mind if people join them to jog, provided you no go try to slow dem down. If you dey slow down, dem go run pass you. If you fit run like dem, you go just join dem dey sing dey go. As teenagers, some of us dey follow dem dey run, because e just dey sweet us to fit run with these military men. Even on days wey navy men no dey run, a lot of people - both old and young, dey still come out for morning to run.

I remember say for our different cultures, e get many things wey people de do to enjoy themselves and to stay fit. Some tribes get special days for wrestling where people go gather dey beat drums, chant songs for their person and cheer the wrestlers until one person back go touch ground. You remember the famous Okonkwo and Amalinze the Cat, from Things Fall Apart by Chinua Achebe?

I remember play play for school. We extend a lot of the play from house to school. Break time no be small thing. Then inter-house sports competitions dey too. Na the biggest event for the school calendar every year. In fact when at  a certain time of the year, every weekend you go see children wey wear their different House colours dey go school with their parents for inter-house sports. Na our own Olympics be that. For primary school my house dey like Nigeria for London 2012, but for secondary school my house dey like USA! Plenty singing and dancing when dem go award us the trophy o.

Now I look around and most of the things wey I remember, done disappear. We all dey sad say Naija perform very badly for Olympics and everybody dey shout about reform of the Sports Ministry and Sports Federations and grassroots sports development. That na good shout. But you see, the problem of our sports no be just say nobody send for grassroots development. E pass like that.

When I small, I no know how small pikin fit take stay inside him house when others dey play outside. E hard o. If you look around now you go see children wey no dey play at all. Dem either dey watch Africa Magic or dem dey watch cartoons, depending on their level of aje. As dem dey grow up, e go change from Cartoon Network and Disney Channel to MTV and E! where dem go discover the Kardarshians and My Super Sweet 16 and na there their own finish! Dem papa and mama no de allow them go outside. So, dem no fit run around or mix with other children or climb trees.

But wait first o. Even if parents allow dem go out, na which tree dem go climb sef? All the trees wey been dey around, done disappear finish. Government done sell or dash dem to people wey done build house everywhere! I remember the parks and playgrounds wey we been get all over Port Harcourt. Public places dey to play football and basketball and even swim. For places like Elekahia Housing Estate, gardens dey where people dey go relax and children dey go chase butterflies. I no fit remember the last time I see butterfly sef. That garden done enter voice mail since! The one garden wey the present government do now, fine well well, but dem put am for express road! I no sure how person wan let him children go play for express road garden o!

Now, even if the parks and playgrounds still dey everywhere, people go really let their children go play? The primary duty of every papa and mama na to take care of their children in the best way wey dem fit. And our country be as e get now, which person get strong mind to let him pikin comot for house just to go play? People wey dey kidnap dey one corner dey do their own, while people wey dey bomb dey their own corner too. Then you get plenty people for road wey dey drive motor and ride bikes like say evil spirits dey pursue dem. How any papa and mama, wey their head correct, go wan let dem pikin just go outside to play na?

Now anybody wey think say the children fit play for school these days no dey live for Naija. Because most of our government schools dey useless, anybody wey get small money dey put him pikin for private schools. Every year, more and more people dey send their children go private schools. And if you done see most of these private schools, e dey easy to understand why children no fit play. Most of them no even get enough classroom space sef, before dem go get playground. So where the children wan play and how dem wan take do inter-house sports?

The Paralympic Games done almost start. And na wetin make me remember Olympics wey I done try to forget. You done see our primary and secondary schools for disabled children? Na just like most government schools. Dem dey rotten dey go. Unfortunately, we no get private schools for disabled children. How this people dey manage, na only God sabi. But we dey expect medals for the Games abi? Yes, by the grace of the Nigerian god.

At the end, the question be say ‘how children wan take develop interest for sports and develop whatever talents dem get, if dem no get the chance to play?’

We all agree say government need to do something about sports urgently. But no be just about more money for the ministry or kicking out the corrupt officials and putting new blood. Government need to go back to their basic work. That work na to care for us just the way parents dey care for their children. Government need to keep us secure, protect our environment so that we go fit enjoy life, provide education of a high standard for our children (including the disabled ones), provide world-class health care facilties, etc. If government do these things, children go begin play again. And if children begin play again and our Sports Ministry plan well and implement the proper programs, e no go tey before we begin do well at every level of sports.

I go still dey follow the Nigerian athletes for the Paralympic Games. Maybe, dem go give us wetin we no been get for the Olympics Games. But even if dem no fit, I go still dey hail dem. To do wetin dem dey do, no be beans.


This na @nfsqueezed on Twitter

I dedicate this piece to the special person wey write am with my hands.
Read more >>

Tuesday, August 21, 2012

O Na For Opposition

by Unknown
If e get something wey we sabi do for this country, na to yarn. Nobody fit accuse Nigerians of not talking. The only wahala there be say we dey spend too much time dey yarn about the things wey no really important, and we no dey yarn enough about the important things.

I read Nigeria: A Case Of Too Many Purposeless Cooks by Debo Adejugbe last week with a mixture of happiness and sadness. I happy because e be like say the guy dey read my mind as e dey write. I dey sad because, I get a strong feeling say if we continue the way we dey go today, we go dey sing the second verse of the song we dey sing now after 2015. The song of ‘how we manage enter one chance?’ So we need to talk about am again and again and again…

On the fact say we need our country to start to move forward, we get general agreement. On how the country go take change, agreement no dey. Everybody get him different idea. Some of us believe say the change wey we need na personal thing. So, if you or your person manage enter government, and things begin happen for una side, then life go change sharply, therefore Nigeria done change. Make una fall inside gutter and break leg! A good majority of us done leave am for the hand of the Nigerian god. Dem believe say if we continue to dey pray without season (or maybe na ‘ceasing’), one day the country go change. I wish dem good luck. I no sure if I intend the pun.

The one I wan really talk about na the third group of people. Dem know say for the country to change, we need a change of personnel. And na every four years we dey employ, sack or renew the contract of the ones wey we already get. Na elections I dey talk about. We know say most of the people wey dey lead us today deserve ‘sacking’. But if we sack dem, we need to put in people wey we believe say go give us wetin we dey look for. And that na where the opposition suppose come in.
In other parts of the world wey their heads correct, if government dey misperform and the opposition dey offer the people something wey make sense, the people dey kick the government out and give opposition the power.

This opposition wey I dey talk about no mean people wey their party different from the ruling party o. I mean parties wey dey actually ‘oppose’ the government. These na parties wey dey monitor wetin government dey do and offer the people something different if dem no agree with the government (and that disagreement na almost everytime). And normally dem suppose to dey do this work in a way wey all of us go see say dem different from the government. In the way dem dey talk, in the way dem dey stand on matter wey dey enter the legislature (both national and state) and in the way dem dey address national issues.

Naija Opposition: Same as the government?
For Nigeria, the opposition suppose be the ACN, ANPP, CPC, etc. But look all of dem and see if difference dey between dem and the PDP. If tomorrow we vote ACN or CPC into the presidency, how dem go dey different? I no sure. As Debo Adejugbe talk, e be like say the only thing wey the non-PDP people get for their mind na to ‘capture power’. So after dem capture power, what next? E no be like say dem dey sure wetin dem wan use the power do.

As I understand am, opposition no dey start 6 months to election. Opposition suppose start from the day dem swear the government in, and e suppose continue till the government commot. Opposition suppose dey mark government like defender dey mark attacker for football, and once in a while we suppose dey see sliding tackle! As the government dey bring policy, the opposition suppose dey bring their own to show Nigerians the difference. That way, the government go dey think twice before dem open mouth to yarn or decide to do something.

The fuel price increase of January 2012 na huge opportunity for the opposition for Nigeria to show us wetin dem dey about. The way I see am, na big New Year present wey the government been give dem. A gift of very strong rope wey dem for use hang the government. In other correct countries, the opposition for jump on top am and by the time dem finish with the government, you no go buy government with 10 kobo! But wetin our own opposition do? Nothing. A few people come out against the fuel price increase, but no be wetin I dey talk be that. As political parties, these people suppose show strength. That for be the time to tell Nigerians how dem dey different. E for be the time to tell us say dem go be government for the people if we give dem power. Instead, wetin we actually hear be say the non-PDP governors been done already agree to the fuel price hike na him make dem all close their mouths.

What about the opposition legislators wey dey the National Assembly? I mean the Minority Leader and all him people. How far with them? How dem dey try to attack and modify the policies of the government? How many bills dem done sponsor and try to push through? Apart from ‘I concur’ and ‘I second’ e get any other thing dem dey talk for there? Or true true na a case of ‘when you dey chop, no talk’? Because, opposition or not, plenty pepper still dey rest for their side!

We need to begin focus our energy on the opposition as we dey focus on government o. Because we no go bring people from another country to come take over the government. A strong opposition na the only alternative.

As e be now, plenty time done already waste, but time still dey to clean the mess before 2015. Because when play play go turn to players, no be me and you wey dey use Twitter and read news online go matter. Na the millions of Nigerians wey no sabi wetin internet be or get time to read newspaper go go out there to vote. Dem plenty well well and na their votes go make the difference. Na the people wey the opposition suppose dey try to reach now with their structure, yarning and most importantly with their actions. That way, when the time come, Nigerians go do the right thing.

I done talk my own, but make the talk continue. Make e continue until we begin do the right thing.


This na @nfsqueezed on Twitter
Read more >>

Tuesday, August 7, 2012

Naija Grammar

by Unknown
Today yarn go start like say na English class. Abeg no vex. I know say you no been like that your English Language teacher for secondary school. Try no extend the hatred reach my side. But if you no fit hold yourself and you still dey provoke, then just take the annoyance read wetin I write finish and drop comment about how I make you vex!

We be country of people wey sabi yarn. And if we manage sabi one or two big word dem, then the yarning dey even sweet pass. Normally, the way people dey yarn no dey worry me. But e get two things wey we dey yarn all the time for this country wey dey worry me. Dem dey worry me because we done bend dem from wetin oyibo say dem be to wetin we feel say dem suppose be.  Forgive me for the plenty grammar wey you go soon read, but I need to quote wetin dey for book so we fit see the real meanings.


Empower (Oxford World English Dictionary)
verb
[with object and infinitive]
give (someone) the authority or power to do something:
                members are empowered to audit the accounts of limited companies
[with object]
make (someone) stronger and more confident, especially in controlling their life and claiming their rights:
                movements to empower the poor

carry along (Longman Dictionary of Phrasal Verbs)
1.    to carry something with one (synonym carry about)
2.    to cause (someone) to share one’s feelings, opinions, etc.
3.    to encourage (someone), as to keep trying.

A few years ago, just some months after Amaechi become governor of Rivers State, I been dey one joint dey do joint things and gist with my guy. As e dey always be with boys talk, the gist come enter government matter. The guy say Odili (a former governor) better pass Amaechi. So I ask am why e talk so. The answer e gimme na simple one.

‘Odili been dey carry people along. Amaechi no dey do like that.’ Na wetin e yarn.

I look my guy with shock. ‘Just that?’

‘Yes o! The guy no wan empower people.’ E continue. Then e go on to explain wetin e dey talk about.

As e explain am, for Naija ‘empowerment’ and ‘carry along’ get different meaning o from the ones wey I copy from dictionary. When we talk say we want our government to empower us, we mean say we want dem to dash us money. When we say we want dem to carry us along, we mean say we want them show us where we go dey thief our own money as dem dey thief their own! When the guy finish the explanation, I no know where to begin address am from. So, maybe the meaning of ‘carry along’ no too far from wetin oyibo talk. Dem say na ‘to cause someone to share one’s feelings, opinions, etc.’ I dey suspect say we interprete ‘etc.’ to mean ‘loot’.

Just like the other guy wey I recommend ‘government slap’ for last week, na wetin been dey my mind for this guy too! No part of wetin the guy explain to me get anything to do with to good government and leadership. The only thing wey matter be say extra money dey enter people pocket.

During Odili time, our state turn to playground for every young man wey wan become Rambo. Our politicians wey say dem must win election or siddon for political seat for second term, buy weapons give these young men. And dem turn Port Harcourt and the towns and villages wey surround am to battle grounds. Small boys go just enter one backyard, dem flog dem 24 strokes, cut their body with blade, rub some white chalk put inside, give dem coloured kaikai to drink, give dem gun to carry and dem done turn gang member/cultist. Na so wetin we dey call militancy now for the Niger Delta start. Where the thing change from fight for political power to fight for the progress of the Niger Delta na tori for another day. But the thing be say, people been no know peace that time. When Amaechi come, things change. Most of that nonsense stop. This no be endorsement for Amaechi. Na wetin happen be that.

So e dey turn my belle say some people still think say Odili time been better pass, because him ‘empower’ dem and ‘carry dem along’. Na serious matter wey suppose make us begin think well well. So if  money dey enter person pocket, e no matter if bullets dey fly pass him head, eh?

‘So you for like make e carry you along, and then you go hide inside house dey drink this drink because you no want somebody to come shoot you, abi?’ I ask am and e no fit answer me.

The sad thing be say, no be only that my friend dey think like that. Na very common way to think for Naija. And trust our sharp politicians. Dem be part of us, so dem understand how we dey think. Dem know who to ‘empower’ and who to ‘carry along’ and things go dey move well for dem. Dem go come up with one ‘Youth Empowerment’ or ‘Women Empowerment’ scheme and people go begin jump and clap hand. Some people go gain small because pepper go rest for their side. For others, contracts, wey dey benefit only the contractor and the politician, go reach their hand and dem done carry dem along be dat. But for us, as people and as communities, nothing dey happen.

We need to live in peace, make money and live well o. But for these things to happen, our infrastructure, economy, and security need to improve. And those things na government work. We need to ask government to do government work wey be to provide the correct environment, so that ordinary citizens fit do the citizen work, wey be to work hard, start business and to create jobs.  That na empowerment. And when government dey do this government work, make dem dey yarn with the citizens, so we too fit put mouth, and we fit tell dem the way those things go work well for us and we fit understand each other. That na to carry us along.

The change, wey we dey look for, dey for our hand.


This na @nfsqueezed on Twitter



Read more >>

Friday, August 3, 2012

E Dey Sexy To Know

by Unknown
‘Imagine that! So, even the British can make mistakes, eh? Look at how they spelt Switzerland.’ The babe dey point television dey talk. This na the day after the London 2012 Olympic Games Opening Ceremony and we dey watch a replay of the ceremony.

I look wetin she dey show me and I tell her say ‘That no be mistake o. Na Swaziland be that and na country of its own.’

‘That’s not true. Is it because the people are black? They have black people in Switzerland too. These guys have messed up! How can they change Switzerland to Swaziland and you say it’s not a mistake?’ See the babe dey blow grammar, dey drag wetin she no sabi with me.

‘You wan bet?’ I ask her. ‘Then we fit use Google Search for your Blackberry take check am.’

‘Well, I don’t have Google Search on my phone, but I know Switzerland and it’s in Europe’ She dey yarn with open eye.

I just shut up my mouth and gum my eyes for television. Because, if I look her two times, I fit yarn something wey I no suppose yarn. So this girl no know say her Blackberry dey do things apart from BBM, Facebook and Twitter, eh? She never use Google search for anything for that phone since she get am! 

This yeye discussion make me remember one like that wey happen two weeks ago. I hook up with one of my friends wey I never see for a long time, and as those kind things dey always be, we begin dey gist about our friends wey we never see for some time too. When e ask me about one of our guys wey be petroleum engineer, I tell am say the guy done get transfer go Norway and na there e dey work now. The thing wey follow next, just make me tire.

‘That na good one o. I hear say dem get plenty oil and money there. All those Arab countries with too much money. Me sef go like enter somewhere near there o. Somewhere like Kuwait or Qatar…’ The guy just dey yarn dey go.

‘O boy Norway na European country o’ I quietly tell am.

‘Na wa to you o! Dem get oil for Europe? Why you dey yarn this kind yarn?’ The guy wan drag with me.

Courtesy wherearemyabs.com
After a few minutes of argument, the way the guy take finish the gist na ‘If you say na so e be, then I believe you. Na people like you dey know this kind useless things sef. Afterall, wetin I dey carry am do? Dem dey pay person money to know am? I no be Sabinus.’

‘Wetin you come be? Ignoramus?’ I no talk am o. I just think am. I just dey look the guy dey boil. See guy wey get daughter wey dey kindergarten. This guy need somebody to tear am better slap! E no go be me, because I no dey roll like that... I mean say, who go pick my pieces when e finish with me? But I no go mind if e find trouble and somebody just tidy am up. I dey talk of proper government slap. You sabi government slap? Na that type wey when e touch you, the hand dey cover your mouth, nose and maybe eyes, and you dey feel the pain even for your ears. You go also dey hear sounds wey dey like Halleluyah Chorus remix by Terry G.

Seriously though, this kinds of discussions dey make me tire. Nobody on this earth fit sabi everything. That na true talk. But as a person, at every stage you dey for life, e get things wey you suppose to sabi. If you no sabi these things too, no be crime. Afterall, law no dey for that kind of thing. Wetin suppose be offence na when you find out say you no know something and instead of you to jeje learn that thing you either begin dey drag like say you na your papa act ‘Dragon Forever’. E suppose be offence too if you begin dey act like say e dey cool or sexy not to sabi anything.

Most of us love our country well well. Some of us dey pretend not to care sha. But all that na wash. See as people like me wey no too send for Basket Ball stay awake last night to watch as USA wan take their father play! As the game finish, we people just take vex begin ‘twitter-beat’ Ghana people! (Ghana no vex, na where our power reach be that). Seriously sha, we love our country and we all know, our government done fail us scatter. Everyday wey we wake up and believe say e no fit bad pass as e dey, e be like say we dey challenge dem. Before the day go end, dem go show us say we never see anything. So, all of us dey find change. Okay, maybe no be all of us (because as the country dirty like this, some people be like pigs), but a lot of us want change. We go like make our country begin grow again, make we get peace, security, electricity, roads, job, etc. And we go like make this change happen sharply.

But for us to drive that change, for us to push other people to do wetin dem suppose do, we need to ready ourselves with knowledge. We need to know our world and how things dey work for other places. We need to know about each other and our differences. We need to dey learn new things constantly. Even our different religions dey direct us to continue to dey learn new things. No be the Bible wey talk for Proverbs 18:15 say ‘Intelligent people are always ready to learn. Their ears are open for knowledge.’ [New Living Translation]? What about the Prophet Mohammed (SAW) wey say ‘O my Lord! Increase me in knowledge [Koran, 20:114] and also order Muslims to ‘Seek knowledge even in China’? E mean say excuse no dey why we no suppose to try to improve ourselves.

And before you begin hammer our educational system, make I explain say no be school I dey talk. We know say our bad educational system dey contribute to wetin dey worry us, but as individuals, that excuse no correct. ‘Dem no teach me for school’ no be reason why you no suppose know say Obama na president of the USA. 

As some people wey get sense done talk before, whatever change wey we dey look for need to start with us. In fact, we need to be the change wey we dey look for. So therefore, na each of us responsibility to gather knowledge. Whether na to read books and newspapers or listen to/watch the news or watch films (I no talk say tune to Africa Magic and throway the remote o!) or ask questions, e no matter. The knowledge fit no be something wey we go use immediately; e fit no be something wey go put money for our pockets now now. But, a day go come when we fit use wetin we know to better ourselves, the people around us and maybe our country too.

That my friend wey no fit find Google for her Blackberry just call me. E be like say she done see am…. She dey sound a lot more... ehm…. Off I go!


This na @nfsqueezed on Twitter


Read more >>

Tuesday, July 31, 2012

That Man Scent

by Unknown
For the past few posts, I done dey yarn about our national wahala and things wey I believe say suppose dey different. Today, I go leave that yarn small and enter a different kind of wahala wey I dey encounter sometimes.

Last week, I dey hurry go somewhere, to go see somebody wey wan do something for some…  Anyway, I run come out of the office wey I dey and luckily I just see one empty taxi. I open the taxi door, jump in, tell the driver where I dey go and him tell me price. Then the ‘scent’ hit me! I try to open mouth talk, but e no gree me open, so I just dey look the guy. E be like say the guy feel say na the price wey e tell me na him make me dey look am like that, because e reduce am immediately from N1000 to N750. I still dey look am! E just dey like say make I drop from the taxi immediately, but when I look outside and see the multitude wey dey wait for transport too, I strong mind, tell the guy to move. 

The guy ‘aroma’ na die! And no, I no mean say the guy na amala and okro soup o. I dey talk of the type we dey come out when person dey get beef with bathroom. You know that type wey, when you enter church and siddon near person, the scent go just reach u sharply and you go know say e no go be good Sunday service, abi? Then small time pastor go begin talk something about ‘lifting up holy hands’. All you go dey think na ‘Pastor, no try am! No try am o!’ Yes, na that one! E dey make you no fit breathe and make tears wan comot for your eyes.

 As we begin move, the guy begin gist me how traffic dey very bad, and how the strike wey tanker drivers been go dey make fuel scarce for town, and him just spend plenty money buy fuel, and him wife just…. Plenty plenty yarns! The guy no gree stop. The ‘scent’ wey dey come out from him mouth make me dey wonder if e drink garlic juice before e leave house or whether na garlic-flavour toothpaste e use wash mouth that morning. I no just know how to take tell the guy to shut up and just drive quick before I quench inside him taxi. I close my mouth, put nose for window and just dey look outside until we reach where I dey go. I pay am sharply, look him face well well, so that wetin happen that day no go repeat itself, and I waka. 

I yarn about the matter for Facebook that day and many people just dey laugh about am and some girls take am dey yab guys. Dem just dey yab us as if we no know say dem... nevermind, that one na another tori. But e get some comments wey make me begin wonder. One guy yarn say to use deodorants and antiperspirants no dey ‘manly’. Another person talk say even if man no feel say him body dey smell bad, then no need to use deodorant. The guy no finish there o. E also say him own body na special one; and if e no baff for some days sef, him ‘scent’ na still perfume!

Guys, I no fit believe wetin I dey read. Seriously, for this century wey we dey so, people still dey think like this? Young and educated people o! E no dey make sense to me. So, according to the first guy, e good for women to dey walkabout dey smell fine, but for men na different matter. If you be man, and you take action to make sure say you no smell like soured something, then you no be proper man again. The second guy make me begin wonder if some people no dey actually smell themselves. Maybe some people nose done get immunity from their own odour. I sure say this particular guy no dey smell himself. Because, if e dey smell himself, e go know say after some days wey water no touch him body, e go dey ooze!

See as I understand am. The way a person dey smell dey na matter of how ‘clean’ the person dey. If you be durty person, you go ooze! If you brush your teeth and clean your mouth well, ‘baff’ well and use wetin you suppose use on your body, then you suppose dey fine. You no go ‘mistakenly’ kill somebody for road or for public transport with your aroma. E no matter whether you be man or woman. If you do all those things and you still dey walkabout with ‘scent’ wey no correct, maybe na hospital or prayer house or babalawo matter be that.

These people wey dey carry their body wahala come dey worry us for public no dey fear God? We get plenty wahala for this country wey we dey face everyday and we no really need their own. As for that my guy wey dey yarn say e be everlasting perfume, I get plans for am. The next time I dey go see am I go carry Air Freshener for bag, just in case… I no fit shout.


This na @nfsqueezed on Twitter


Read more >>

Friday, July 27, 2012

Like Oliver Twist

by Unknown
About two weeks ago, I dey one airport for Africa with my Asian colleague and we just dey discuss travelling and other things. Then the guy say,

‘This airport is alright but too disorganised. If they organise it better it’ll be nice.’

For one moment, I surprise small and just dey about to answer ‘This airport? Are you kidding me?’ but I think am again and just nod my head and smile. Wetin the guy talk na true. No need to argue.

This airport wey we dey talk about so na correct one. No be like Murtala Mohammed Airport wey when Police search you bag finish, dem pass am to Army; Army finish dem pass am to Navy; Navy finish dem… you get the picture. Things dey work well, and you no fit waste time for there. The only issue be say e get plenty airports for Europe and Asia wey correct pass am for organisation.  And that na wetin my colleague dey talk about. The airport good, but e still need improvement.

The thing wey happen to me, na wetin dey happen to most of us for our country. We done live for country where things no dey work at all, so that every small thing wey work, na blessing. For example, a Governor go give contract make dem repair bad road and all of us go dey happy, dey praise God and the Governor. We dey forget say na this same Governor give the contract wey dem take construct this road two years before. And if to say dem do better work, the road no go need patching. Or you go to enter flight scheduled for 7am and the flight leave at 8am. People go say ‘Thank God o! Na only 1 hour delay. Normally, e dey pass like that.’

Oliver Twist courtesy Jake Parker
Even some of us wey done travel to places where things dey work well sef dey do the same thing. Somehow we no dey feel say we fit get those same excellent standards for our country. So, we no dey expect good service, infrastructure, leaders, etc. Because we no dey expect those things, we no dey complain when we no get them. We no dey demand for them. When we get pass wetin we dey expect, we go give thanks like say we done get the whole world. But deep down, we know say wetin we get no reach standard.

We know say to thank somebody for something (even when na him job e dey do) na good thing o. But after we say ‘thank you’, nothing stop us from being like Oliver Twist and to say ‘I want more’. We deserve more. We know say we fit get more. Governments and businesses for other countries dey provide more for their people, so why not our own?

We need to change this culture of not demanding. We need to demand things from our politicians, leaders and our government. We need to demand things from the people wey dey provide us services – telecoms, transportation, media, etc. We need to demand things from each other. If we no demand, maybe some people no go realise say dem dey misbehave. Dem no go know say dem performance no reach. And some people wey know say dem no dey perform, no go get any reason to improve.

As D’banj talk ‘I wanna have them all…’ we fit ‘have them all’. Not the ‘them’ wey D’Banj wan have o! But we fit get those things wey we need for our country.


This na @nfsqueezed on Twitter


Read more >>

Tuesday, July 24, 2012

We Want The Opium

by Unknown
Na Karl Max wey talk say religion na the opium of the masses. Meaning say na wetin we dey use ‘high’ ourselves so that we no go face reality. I agree with am completely on the issue. But I also know say opium no be for dulling alone. E get other very good uses wey make am important. Na so religion be too. And before you begin ready to call down the anger of God for my head, this yarn no be about religion, so make we move on.

Courtesy cutesexyfunnyawful
Like most Nigerian guys, I love football. I no really know why I love am. I just love am. I believe say e dey my blood. I say e dey my blood because I know say my grandpapa been love am too. I fit remember as me and him dey siddon with him old ghetto blaster dey listen to Radio Nigeria football commentary. When Naija dey play ball and light no dey to watch am for TV, na the style be that. The way commentary been dey those days, we go done shout ‘goal!’ like 5 times before dem actually score one! We no mind sha. We dey enjoy am.

I also remember say when Enyimba win the CAF Champions League final with penalties, I no fit watch the match where I dey. So, I use my phone to listen to commentary of the shoot out! And I jump and jump when dem win. Yes, I love Naija football reach like that, and I know say I no dey alone for that situation.

In fact we plenty wey be like that. Just check out the way people dey stand in front of any building wey get TV wey dey show football on weekends and you go understand. I look back now to the period between the late 80s and mid 90s, when Naija football been solid and I wonder. Though we been never begin watch the Premiership or Champions League as we dey watch am today, we been like our local league and our national teams. And e look to me like say instead of just religion then, na religion and football been be our opium.

If you no believe say we use football dey ‘high’ ourselves, then you no remember Japan ’93, Tunisia ‘94 and Atlanta ’96. The kind of attention wey we give those competitions and the kind of joy wey we get when we finally win, no get mate. For ’96, at a time wey Sani Abacha done turn our country to wetin-I-no-fit-describe, I remember women dey run for street with happiness and wrapper dey fall from their waist! People dey carry wooden Olympic Torch, beat drum and sing for street for 2am! Somehow, for the period wey we go talk about and watch the football, we dey forget all our problems. That na unless NEPA take light o! Because, we done hear stories of how people go beat NEPA officials because light go during football.

These days, things done change. Our football dey add to our many problems. Countries wey been dey fear when dem hear our name before, now dem dey make noise. And no be just noise o. Some of dem done stop us make we no go World Cup and African Nations Cup. Our teams no dey fit qualify for Olympics again and even the age-grade and female competitions, where we dey shine before, done dey hard us. Which way Nigeria?!

So, now we get a situation where Naija people dey pretend say dem no get interest for Naija football again. We know say na pretend dem dey pretend, because e dey inside blood. You go ask somebody whether him watch the last Nations Cup Qualifier and if Naija been play well, e go say e watch am. If we no play well, e go say e no been know say match dey sef. But I understand say dem dey try to protect themselves from the heartbreak wey dey follow Naija football. People dey soak demselves inside European football and try not to remember our own.

But no matter how European football sweet, e still no sweet reach when we win the Nations Cup in ’94 or the Olympic gold in ’96. That collective feeling of highness na the very one. That joy wey dey cut across all the boundaries of tribe, religion and status for our country, na something wey we no fit measure. E unite us pass the Fuel Subsidy removal wahala for January 2012 sef. Na that joy we done dey miss for years now.

I agree say we get very serious problems for our country. Problems wey big pass football or any other sport. I know say if we begin win football matches again and other countries begin fear us like before, e no go really change our suffer for this country. The suffer go be the same. But then, if we begin win football matches again, na bad thing? True true, to get back to the time when we been dey do well for football go take plenty hard work from different people. The world done change well well and we need to do something to catch up. I know say we fit do am, but whether we go actually do am na another matter.

But, like the person wey done take opium before and we know the sweetness, I know how e dey be when Naija win football competition and I no go mind to ‘high’ myself again. Because now, more than before, we need something to (once in a while) comot our minds from the way our country be. We need something to give us joy, even if na for a short time.

If you say I be addict, I go agree with you. If you say my head no correct, maybe I fit argue small. If you say I need rehab, I no go gree. I no need cure. For our country, this football drug good for us. E dey work magic. So, somebody… anybody… abeg give us the opium!


This na @nfsqueezed on Twitter

Read more >>