I remember when I small. No
kind play children no been dey play - backflip, cartwheel, rubber leg, running,
high jump, long jump and even poju poju. My street na 100m track for us
children. No evening wey you no go hear ‘On your marks, set, go!’ outside our
house. Our parents dey actually come out for our houses and watch us as we dey
arrange ourselves dey run. We dey make small small ‘machines’ wey get wheels
and dey push dem all over the place. Some of us dey carry old bike and motor
tyres dey run for street. Sometimes they tyre dey even big pass the pikin wey
dey try to push am. We been dey wrestle too. Those of us wey from villages wey
dem dey wrestle come introduce am to us. But we no dey do am where our parents
go see us. If not, na cane we go wrestle with. We bin play many games wey if to
say we do am till we grow we for be professional play play people. I mean, I
been dey very good with my catapult. I dey shoot anything wey dey move. I enter
trouble a few times because of am too.
I remember say the navy men wey
dey stay for the NNS Pathfinder Base (that time na NNS Akaso) dey like to jog
for morning. And dem no dey mind if people join them to jog, provided you no go
try to slow dem down. If you dey slow down, dem go run pass you. If you fit run
like dem, you go just join dem dey sing dey go. As teenagers, some of us dey
follow dem dey run, because e just dey sweet us to fit run with these military
men. Even on days wey navy men no dey run, a lot of people - both old and
young, dey still come out for morning to run.
I remember say for our
different cultures, e get many things wey people de do to enjoy themselves and
to stay fit. Some tribes get special days for wrestling where people go gather
dey beat drums, chant songs for their person and cheer the wrestlers until one
person back go touch ground. You remember the famous Okonkwo and Amalinze the Cat,
from Things Fall Apart by Chinua Achebe?
I remember play play for
school. We extend a lot of the play from house to school. Break time no be
small thing. Then inter-house sports competitions dey too. Na the biggest event
for the school calendar every year. In fact when at a certain time of the year, every weekend you
go see children wey wear their different House colours dey go school with their
parents for inter-house sports. Na our own Olympics be that. For primary school
my house dey like Nigeria for London 2012, but for secondary school my house
dey like USA! Plenty singing and dancing when dem go award us the trophy o.
Now I look around and most of
the things wey I remember, done disappear. We all dey sad say Naija perform
very badly for Olympics and everybody dey shout about reform of the Sports
Ministry and Sports Federations and grassroots sports development. That na good
shout. But you see, the problem of our sports no be just say nobody send for
grassroots development. E pass like that.
When I small, I no know how
small pikin fit take stay inside him house when others dey play outside. E hard
o. If you look around now you go see children wey no dey play at all. Dem
either dey watch Africa Magic or dem dey watch cartoons, depending on their
level of aje. As dem dey grow up, e go change from Cartoon Network and Disney
Channel to MTV and E! where dem go discover the Kardarshians and My Super Sweet
16 and na there their own finish! Dem papa and mama no de allow them go outside.
So, dem no fit run around or mix with other children or climb trees.
But wait first o. Even if
parents allow dem go out, na which tree dem go climb sef? All the trees wey
been dey around, done disappear finish. Government done sell or dash dem to
people wey done build house everywhere! I remember the parks and playgrounds
wey we been get all over Port Harcourt. Public places dey to play football and
basketball and even swim. For places like Elekahia Housing Estate, gardens dey
where people dey go relax and children dey go chase butterflies. I no fit
remember the last time I see butterfly sef. That garden done enter voice mail
since! The one garden wey the present government do now, fine well well, but
dem put am for express road! I no sure how person wan let him children go play
for express road garden o!
Now, even if the parks and
playgrounds still dey everywhere, people go really let their children go play?
The primary duty of every papa and mama na to take care of their children in
the best way wey dem fit. And our country be as e get now, which person get
strong mind to let him pikin comot for house just to go play? People wey dey
kidnap dey one corner dey do their own, while people wey dey bomb dey their own
corner too. Then you get plenty people for road wey dey drive motor and ride
bikes like say evil spirits dey pursue dem. How any papa and mama, wey their
head correct, go wan let dem pikin just go outside to play na?
Now anybody wey think say the
children fit play for school these days no dey live for Naija. Because most of
our government schools dey useless, anybody wey get small money dey put him
pikin for private schools. Every year, more and more people dey send their
children go private schools. And if you done see most of these private schools,
e dey easy to understand why children no fit play. Most of them no even get
enough classroom space sef, before dem go get playground. So where the children
wan play and how dem wan take do inter-house sports?
The Paralympic Games done
almost start. And na wetin make me remember Olympics wey I done try to forget.
You done see our primary and secondary schools for disabled children? Na just
like most government schools. Dem dey rotten dey go. Unfortunately, we no get
private schools for disabled children. How this people dey manage, na only God
sabi. But we dey expect medals for the Games abi? Yes, by the grace of the
Nigerian god.
At the end, the question be say
‘how children wan take develop interest for sports and develop whatever talents
dem get, if dem no get the chance to play?’
We all agree say government
need to do something about sports urgently. But no be just about more money for
the ministry or kicking out the corrupt officials and putting new blood.
Government need to go back to their basic work. That work na to care for us
just the way parents dey care for their children. Government need to keep us
secure, protect our environment so that we go fit enjoy life, provide education
of a high standard for our children (including the disabled ones), provide
world-class health care facilties, etc. If government do these things, children
go begin play again. And if children begin play again and our Sports Ministry
plan well and implement the proper programs, e no go tey before we begin do
well at every level of sports.
I go still dey follow the
Nigerian athletes for the Paralympic Games. Maybe, dem go give us wetin we no
been get for the Olympics Games. But even if dem no fit, I go still dey hail dem.
To do wetin dem dey do, no be beans.
This na @nfsqueezed on Twitter
I
dedicate this piece to the special person wey write am with my hands.